Military ex-boys & soldiers fond of harassing MOUAU students at night inside school.....

Dis tori no sweet me atall, so i say make i yarn am for pigeon! *bonesFace*..

i hear say some people wey de claim say dem be ex-boys abi soldiers de harras students wellu wellu for MOUAU especially for night.. say dem go come around old female hostel begin de shine torch like people wey shack shayo because say dem wear uniform and say students go de take off especially the she-males wey sabi fear like bonga fish!
abeg and abeg na beg i de beg.. i wan tell our C.S.O and Ekedo make dem look into dis mata before umudykes go vex scatter their dada because say na inside school we dey o! and we know our rights as Nigerian students o!
 dis message is from the GREATEST UMUDYKES!
we no de carry last na why our school motto na UNIVERSALLY COMPETENT!
*walksAwayToFindMoreNews*....


Next PostNewer Post Previous PostOlder Post Home

1 comment:

  1. na true o.. dem don pursue me before ..lmao

    ReplyDelete